poetry...

Dearest reader, I have no meaningful insight to present thee, this day, hence, I present to you my first ever pidgin English written poem

Let me know in the comments if you liked it, could relate and what you rate it on a scale of 1-10;


Omor, I Don Tire

Omor, e no dey well
I don tire to dey talk say “it is well”
When my chest no feel well

I don tire to dey hope,
To dey believe say e go better,
When better dey form ghost for my front

I don tire to dey cry,
To dey believe, hold my heart for hand as I dey grind everyday
I don tire to dey beg God make my hustle show face,
Make my sweat no waste, make small light burst from this dark

I don tire to dey pretend
To dey act like tomorrow sure,
When I never even sabi how I go reach there
I don tire to dey look the bright side,
When the whole world dey dark like street wen transformer don blow

I don tire to dey “aspire to inspire”
To dey wear fine cloth hide shame
I don tire to dey smile anyhow,
Show all my 34 teeth, make nobody see the tears wey dey hide for corner of my eye

I don tire to just dey go on
I wan live, no be just survive
I wan rest without tears for my pillow every night

Papa God, abeg show face
Because your pikin don dey break small small
I dey try hold on, but e dey hard
Abeg, come through before I give up finish


XO favvyOkwans✨

Comments

Popular posts from this blog

"NOT ADMITTED"

TEAM WORK

LESS THAN ONE.